Di tru tori of Jesus
Watch di tru tori of Jesus
Kom visit di page
Pipo dem don pray
You get for sabi say if you bi pray praya for get salvation, you don turn be na God E pikin.
“But if you confess wit ya mout sey, Jesus Christ na Oga God and you beliv for ya heart sey, God bi wake up E from di grave, you go get salvation.” Romans 10:9
You fit pray with we now for get your salvation:
Dear God,
I confess say Jesus na Lord. I beliv say na virgin born E. E die for cross bikos of my sin dem, and afta three day dem, E wake up from die. Today, I confess say I don sin against You, and I no get somtin wey I fit do for save myself. I beg You, forgive me, and I put my trust for only Jesus.
I beliv say I don become Your pikin now and I go dey wit You inside ya kingdom for eva. Make Ya Holy Spirit dey guide me every day. Help me make I love You with all my heart, soul, and mind, and make I love oda pipo dem just as I love myself. Tank You say You save me thru di blood of Ya Son, Jesus.
For Jesus E name I don pray. Amen.